Prayer request

 Posted by       132 views  Editor's Picks, Poetry
Dec 192012
 

Baba God,

For dis gate

of tears,

Na him I put

my prayer request.

Yet,

after 5 years

You still no send.

 

My life

be like flute,

Wey dey sound

like gen.

My heart

be like fruit,

Wey be poison

to belle.

 

Cloth no fit

cover my shame,

Perfume no dey

hide my odour

Cos I never

change my last name

or bring man come

knock my papa door

 

I be virgin,

I dey fast.

I dey choir,

be church worker

Yet runs girls

like Cynthia

Come even

get husband

 

My pikin,

I see your

prayer requests,

and baggage

for the gate of tears,

But yes, I send.

your husband

since 5 years ago.

 

You remember

Broda Luke

Wey you yab

with your friend

You say e no fit buy

tyre tube

I don make

am millionaire.

 

What about Seyi?

You talk say

him too short.

Becos you

From Itsekiri,

You no even

gree am talk

 

You be virgin,

I gree.

Church worker,

E good.

But you no fit keep,

Broda chidi,

Cos you dey do S.U

Long skirts, no make-up.

 

So my pikin,

Wetin I go do?

My job

na to send husband,

Your job

na to keep am.

Na why I give you brain.

For yourself, make way.

Comments

comments

chika nwakanma @afroxyz

Avatar of chika nwakanma

Go to chika nwakanma's profile, and read more of his/her posts.

  7 Responses to “Prayer request”

  1. Avatar of topazo

    Funny…but na by make up and short skirt dem tey take keep husband?

  2. Avatar of ayistar

    Nice and didactic poem

    *But her dressing should be courteous not tarty

  3. Avatar of Omila

    really nice…even has a ring to it!
    gives me courage to do vernacular.

  4. Avatar of basittjamiu

    it make sense half-way but it was good sha.

  5. Avatar of Efadel

    @ Afroxyz, I like the use of Nigerian pidgin. In defense of God pikin, the poetic persona, maybe when next God sends a husband, he should inform her sot hat she can easily identify him. She shouldn’t be kept guessing. On the whole, it is really an interesting poem.

  6. Avatar of lactoo

    baba God dey try. Its 4 us to keep them.

  7. Avatar of innoalifa

    … a nice poem in the lingua franca of the Niger Delta, love the flow…

Switch to the mobile version of this site