Dis minister sef
Dis kain exhalted minister
Wey we leave our book
Wey we leave our work
Wey we leave our market
Wey we even leave our pickin
Wey we come see
Dis minister sef.
We wait, wait sotee our head come dey knock
We sitdan sotee our nyarsh begin dey pain us
We stand sotee our leg begin dey shake
We wait sotee we tire.
People come dance
Dem dance sotee they tire
Dem dance sotee water finish for their body
Dem dance sotee people sef come tire to dey clap
Where we dey wait for our exhalted minister.
We wait sotee we start to dy colo
We wait sotee
Even dignitaries wey come
Come dey colo sef
We still dey wait
For our exhalted minister
We wait sotee we come dey “dis-illusioned”
(as the boy wey stand near me with big book for him hand take talk am)
Dis minister sef
We wait sotee
Lecturers sef come dey follow dance highlife
Even Lolo follow sef dance highlife
Dem tell us say him dey come now now
Say him dey road
Say him go soon come
We wait sotee sun touch water
And dem still tell us
Say him dey road
We wait sotee sun come even enta water
Dem still tell us say him dey road
Abi road no dey finish?
Dis kain minister sef.


Er…I see the effort, but the pidgin is not quite flowing.
“We wait sotee we come dey “dis-illusioned”
(as the boy wey stand near me with big book for him hand take talk am)
Dis minister sef”
I like that line and your attempt at rationalizing why such a ‘big’ word would appear in such a poem – but did the ‘boy wey stand near you’ also write it?
Nice.
I have always thought of writing in pidgin english. But we don’t have a standard spelling for Nigerian broken English. This discouraged me. Like you probably should have used ‘siddon’ and ‘nyash’
This is not bad. But I leaves no impression on the reader.
@victoria Nice. U did well.
By the way o how is “We wait sotee sun come even enta water” possible???
I see d logic, if na only logic sha. Hahaha…nice piece. Waiting for the savior that never comes. Get Up people and do the DOOOOO. I fink that is wah this is all about, yeah???
@shaifamily am not sure am suppose to explain what i meant but i wud do so, i was only tryin to capture d passage of time n how long they had to wait for the minister, they waited from morning to eventide n yet the minister was still on the way, just trying to capture scenes from cartoons n i suppose in real life when the sun seems to go down slowly into the waters of the atlantic
Okie Dokie…. I see…cartoons. Hmmm….@victoria
not just cartoons
not just cartoons, now don’t be sarcastic shaifamily@ shaifamily
@victoria hehehehe. Hahahaha.
Lemme o!
You tried on the pidgin but some parts were more clunky than others.
On the message, we have to stop waiting for them for real. African time also affects even the non-politicians among us. So everyone has a role to play.
@Myne yes oh
I never appreciate pidgin literature.
@kaycee ve u read Ezinwa Ohaeto?
This is really funny hope it was not the minister for special duties
tnks,n i don’t knw oh
I agree with @Melody, it was kinda funny. And it read like a discussion by three people probably ‘satirizing’ a big dignitary not showing up.
Nice attempt.
tnks
Nice one but I don’t think u got the pidgin part quite right. If u are writing pidgin literature u should show people like @kaycee that their is creativity to be found there too. You were rather economical with your pidgin vocabulary. “Disillussioned” shouldn’t have been used in d poem. On a whole, it’s a good attempt.
noted @omotpla
sory 4 d error in my spelling @omotola
I like it. A beautiful satire.
tnks@ohmston Weth