My people,una sabi say English nor be our papa language. Na why e be say, we wey to speak english be like hot ogbono for mouth, we dey fit yarn, dey gist for pidgin. As na pidgin we dey use, our own people don do some kain remix for di meaning of some kain english word dem. Abi how we wan take yarn as dis girls don remix di meaning of uncle and ‘un-cle’?
Na as i dey waka jeje one day, naim i hear as 2 babes dey talk. As tatafo wey i be, i say make i put ear for ground. Dis na wetin dem dey yarn.
Cynthia: ‘Stella, chei! See plenty money. Wey u get all dis money from? Abi u don hammer?’
Stella: ‘omo meeen. Na so I see am o. I don hammer sha. Na my un-cle give me na’.
Cynthia: ‘babe u get luck sha. Una wen get uncle. Me no get. Na popsy I been ask for money, but im say im no get’.
Stella:’Who tell you say na uncle I ask? Abi you no hear me? I say na un-cle’.
Cynthia:’shoo! Which one come be un-cle na? Uncle and un-cle, nor be di same thing?’.
Stella: ‘dodo. Omo you dey dull o. Dey there dey sleep on top okada. Uncle nor be the same ting with un-cle’.
Cytnthia:’ But how na?’
Stella: ‘See na di same spelling but diffrent meaning.’
By dis time my tatafo antenna come increase im coverage. Becos me sef wan sabi di difference. I think say uncle na the same thing with un-cle, until dis Stella come bring remix, abi na merix?.
Stella: ‘see, uncle na your papa or mama broda. Un-cle na aristo. Those old men wey get pot-belle with plenty money’.
Cynthia:’Okaaay. So na wetin you mean? Hmm, na wa o. Oya na, how you go take connect me na? Abeg i need to meet dis your unnn-clees.
Stella:’No lelle. You know say you be my person. E get one wey dey pipeline now. Make I give you im number. Di guy dey pay wella. No mess up o. Make you treat am well o.
Cynthia:’ ah, ah, you trust na. any how wey im want am; I full ground remain. Im fit come dey live with me for skool sef’.
Na so dem two come dey laff those winch laff. Okpe! So na aristos wey dis small girls dey call un-cle. I come dey remember say sometimes, my babe go say im wan visit im un-cle, me think say na uncle. Omo today today she must confess. And I hear say d is uncle sef dey come drop am for hostel. As I say make I change direction, I begin hear katakata. Woman sef, dem nor fit talk, close mouth. I come tune my antenna make I for hear dia latest amebo.
“Wait, wait, wait o. Stella, na my papa number be dis na. So na my papa don turn your un-cle now abi? Chei! And I ask am money im no give me. Na thunder go hammer two of una!”.
Na so Stella come answer “Abeg, abeg, abeg, nor come spoil show for me o. Nor be person papa you sef for follow flex?”
Hmm, my people, dem say if you follow di hole wey sandfly dig for wall, you fit commot for spirit land. I nor even wait hear how dia matter end, I just waka. But make una remember say uncle nor be un-cle.


This is not fair o
hahaha….ur gf part is so funny
A brave writeup.
Lwkmd! Very funny piece…
Wrong in every way! still hilarious though. Dunno y girls do it oo. they have the same ability to make good cash. Thanks for the giggles
me like it, definitely not easy writing in pidgin. good work!
Thanks for your comments, and yes, its easy to write in pidgin
@afroxyz mehn u funny die o. na so we dey am for skul o. even as early as 7pm, un-cles don come dey pick dia nieces abi na nephews. dem dey spoil for boys like us wey dey trek go class
Beautiful piece Chika. Enjoyed it very much. Well done.