Sep 222012
 

Na true say our Naija people nor dey take religion play. One of di tings wen dey give persin respect for dis our country na to ba pastor, evangelist, bishop, imam etc. Even that book wey dem dey write ogbonge tins wey people don do for this world, Guiness Book of Records, don give us award as di country wen church plenty pass inside am. We follow for people wey dey religious pass for the world. But e be like say as dis religion good, e dey also make us to be mumu. We don allow religion block wetin we dey use think. E be like say we don comot our brain carry holy ghost fire, alleluyah, hozanna and other christian okombo full am. Di ting wey happen one day for bus when i dey go obalende, naim make me yarn like dis.

That day e no easy for guy man, as sun don beat me sotay u fit boil egg on top my head. I enter bus, siddon. As usual we pack like sardine inside di bus as Baba Fela been sing. I still dey vex for the heat and go-slow wey we wan enter, plus the mama wey dey my side wey get body odour wey fit kill fly, wen one man come stand up to preach. I dey sure say if no be wetin happen, nobody for send the noise wey im dey make. Im cloth sef dirty, come get map for the armpit side.

The man begin preach, dey tell us how Jesus come die for us (as if I nor know), how through im name we fit get power to move mountain and wake person wey don kpai (as if im wey dey talk fit do am). Small time di man begin lead praise and e no tey the man begin dey conjour prayer. Passengers wey feel di man, dey follow am dey return arrow back to sender. Wetin concern guy man kwanu, I just dey dia, dey look fine gals wey dey pass for di window side.

As the prayer dey go on, na so person fall yakata for bus. I for nor send only say na fine chic. The girl too set. Im begin dey vibrate, dey open mouth like fish wey dey water. Na so katakata come burst inside motor. The prayer come increase bicos efribody believe say di girl dey under anointing. Me for my small evil mind, I dey wonder why fine girl wey set like dis go come ‘disgrace’ im sef like so. I come dey suspect say na arrangee. Who know na? For Lagos, anyting fit happun.

Omo, prayer come continue o. Infact with that kain prayer, I sure say if Jesus come dat time, im for no judge us. Dat na straight visa to heaven. But the girl still dey shake and e come dey increase. Abi dis one na holy ghost in action? Na so the guy wey dey my side come show me the girl inhaler for im bag. “maybe she dey asthmatic” the guy tell me. I come reason am. Breeze nor too dey di bus, and na dry season so dust fit disturb di girl.

Na so we begin dey tell them say make dem wait make we give am im inhaler. Some mama dem come dey shout ‘Una nor see say she dey under demonic attack? But di guy nor gree, infact na later I sabi say im be medical student. Even di pastor dey abuse us say we dey mock God. Di boy just vex, grab the girl come put am di inhaler for mouth. Sharperly, Sharperly!, di attack come cease.

Trust my Naija peopla na, we nor dey slack. Na so pastor come change am for us, begin dey give God praise for the ‘miracle’ wey just happun. Passengers say na God send di boy to see di inhaler. Na so me and my guy look oursef, shake head.

I come remember wetin my lecturer been tell me for school, say common sense no dey common. Dis talk na true talk. Imagine say dat girl die bicos of common asthma attack and meanwhile our people dey there dey pray, dey vibrate. Apart from wetin happen for that bus, na so plenty Naija people dey live their life. We dey put plenty power for faith, yet we no dey act am. We nor dey use our sense wen we suppose.

Na why our country be as e be bicos we dey fail to do di correct tings. We dey always expect miracle or wonder or say one angel go come rescue us. You go see people dey spend more time dey pray pass di time to dey do dia job. Na so one Naija nurse for Jand go dey pray for one patient instead of make im dey do im nurse work, sotay dat patient die.

My talk be say, even as we dey pray, make we apply our brain to wetin we dey do. Sometimes di answer dey our front, but we go dey waste time dey pray. Well, as yarn am bifor, common sense no common.

Comments

comments

chika nwakanma @afroxyz

Avatar of chika nwakanma

Go to chika nwakanma's profile, and read more of his/her posts.

  9 Responses to “Common sence no common”

  1. True talk my broda.

  2. true talk my broda, ur yarn make brain. na so miracle propanganda dey kill us 4 naija

  3. I can relate with this. True talk. Well done

  4. @afroxyz: u don hit am for im head, gbam! nothing do you

  5. True talk, my brother. Well done

  6. Chai, this tory sweet well well. See as you knack broken brekete for this tory. Well done jare. Na you try pass.

  7. Too many ‘Nkan Nbe’ dey worrey my pipu.

    Beta yarms full inside this tori sha… well done.

  8. Master your yarn go well oh na ignoramous nain dey kill us pass for naija. So my oga u just bam

Switch to the mobile version of this site